2 days ago
Federal High Court for Abuja, Nigeria, don sentence di kontri former minister of power Saleh Mamman go 75 years imprisonment sake of corruption and fraud.
Earlier for May 7, di court bin convict di former power minister on 12 count charges wey border on fraud and money laundering wey di EFCC file against am.
Justice James Omotosho for di judgement say di anti-graft agency successfully establish say di former minister dey guilty beyond reasonable doubt.
Charges against am include illegal diversion of public funds wey reach 33.8 billion naira, criminal breach of trust unto funds wey Nigerian govment release for di Mambilla and Zungeru Hydroelectric Power Project, among odas.
Di court say im go serve im sentences consecutively and must pay back di balance of 22 billion wey dey linked to di Mambilla and Zungeru power project.
Di judgement dey come few days afta Oga Mamman pick form to contest for govnorship for Taraba State ahead of di 2027 general elections under di All Progressives Congress (APC).
Mamman na di minister of power wey bin serve under late former President Muhammadu Buhari, hope we can see more of Nigeria corrupt leaders face justice and been sentenced here @Hungerstopper 🇳🇬🇳🇬💔💔💔#fypシ゚ #justice #fypage #salah #viraltiktok
1
0